Biafra : Wetin IPOB Dey Talk Na True, But Our Fear Be Say Make Anothe War No Come - Gov. Dav Umahi

 MASTER REPORTERS GLOBAL NEWS

Bringing to you Breaking News from around the globe.

By

 Faithful Ihechiluru

 

Di person wey be Ebonyi state governor, Engnr David Umahi don talk say, IPOB  dey talk true, but him dey fear another war.

Gov. Elechi talk dis one when BBC interview am for Government house Abakaliki, as Nnamdi Kanu appear again.

Him talk am say: “True true, wetin Indigenous People of Biafra dey talk na true, but make dem take am easy.”

“Wetin dis pikins dey fight for be wetin I believe, dem don marginalize Igbo people well well,but we dey fear war”

“We never survive di war we we bin get, and no wetin make me tell Nnamdi Kanu before python dance make him see me”

“Nnamdi kanu see me, I carry am go see Southeast governors as dia chairman for Enugu.”

“We tell am say make him take am easy, based on say ndiigbo dey expect presidency 2023, but him no want am. ”

“We dey fear war, e no mean say we no dey support am. Wetin him dey talk nasty wetin dey my mind, and na wetin I believe. ”

“True true, wetin dis pikin dey ask for, dey find and dey talk dey true.”

Share this : 

Drop your comment below

Copyright © 2018 Master Reporters All Rights Reserved.

Previous Post
Next Post

About Author

0 comments: